Falz O Wa lyric

O Wa

Falz Falz
:
22 February 2023
1
0
0

Falz O Wa Lyrics

[Intro: Tekno]

Ey, ey, ey, ey, ey, ey

Uhn, uhn, uhn, uhn, uhn, uhn

Kill person for there

Go hustle for there (Chillz made it)

Go [?] for there

 

[Verse 1: Falz, Tekno]

Na so dem dey do (Olololo)

Pack everybody like sardine

We dey gallivant up and down

Forget say body no be machine (Body no be machine)

All the tax wey we generate

Why the cash no dey circulate?

And when we start to calculate

Everybody come dey agitate

 

[Chorus: Falz, Tekno, both]

Ojota, O wa

Owa oh, Owa

Agege, O wa

Owa oh, Owa

Ojota, O wa

Owa oh, owa

Agege, O wa

Owa oh, Owa

 

[Verse 2: Falz, Tekno]

Give me mineral

Pass me the Gala

Hustle critical

We no fit retire

O jọ cinema

E don turn wahala

Many animal dey put on Agbada

I get medicine wey dey cure anything

E dey cure poverty, bring prosperity

Many things, many things

Everyday, we dey see many things

Because

It's a critical reaction

My country no get formation

Oloun, for your information

Population dey for prostitution

I say dem mama, dem papa

Dem dey cry

Dem no know how pikin dey kpai

Money no dey, he dey drink kai-kai

Kai, haba baba na

 

[Chorus: Falz, Tekno, both]

Ojota, O wa

Owa oh, Owa

Agege, O wa

Owa oh, Owa

Ojota, O wa

Owa oh, owa

Agege, O wa

Owa oh, Owa

 

[Verse 3: Falz, Tekno]

Give me mineral

Pass me the Gala

See I know Sikira

She don hustle tire

The way she dey work, suppose wear designer

But she no be baller, she no know Dybala

I talk my own

I don dey go

Conductor own

He stop for road oh

You get money

You chop alone

E run belle

You purge alone oh

Why you no give me change (Change) I para

Dem dey do us ojoro oh

I curse the driver, I tell conductor say "waka"

Dem dey do us ojoro oh

Stop the motor I need to come down, I tire

Dem dey do us ojoro oh

Patapata everything we scatter

We dey face wahala

Dem dey do us ojoro oh

 

[Chorus: Falz, Tekno, both]

Ojota, O wa

Owa oh, Owa (Owa, owa, oh)

Agege, O wa

Owa oh, Owa (Owa, owa, sẹ)

Ojota, O wa

Owa oh, owa (Wey change, where?)

Agege, O wa

Owa oh, Owa




Comments

You may also like these lyrics

00:00 00:00